January 22, 2026
Spread the love

E tok dis one for one meeting with representatives and leaders of di Niger Delta under do Pan-Niger Delta Forum (Pandef) for Abuja.

President Tinubu say respect for di judiciary dey important to uphold democracy and foster harmony.

Di president advise di leaders to dey more broadminded, selfless and focused on di larger vision of salvaging di region, politically and economically, by insisting say di judiciary interpretations of di Constitution dey respected.

“Yes, Niger Delta na di goose wey dey lay di golden egg. We must care for di goose; odawise, we go lose di golden egg. I get your signal and your concern, particularly on Rivers State. I don dey on di issue for quite sometime. I bin see say di crisis go continue for too long bifor I intervene.

“We reach agreement, written agreement, and both parties bin sign.”

Di President kon add say stakeholders gatz make sacrifices for di state to move forward by recognising di Constitution.

“Please go back home and help implement di court rulings within di shortest possible time. I don put di ball for una court. Help. Privately and openly intervene and counsel di governor. Pursue di path of peace and stability,” e add.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *